“So I tell una, make una nor worry about una life, wetin una go chop or drink and wetin una go wear for body. Life nor big pass food? Abi body nor betta pass klot?
“Make una tink of how flowers dey grow: Dem nor dey work or make klot for demsef. But I tell una true word, even Solomon for all di glory wey e get, nor dress fine rish flowers!