If yu get money from intrest wey yu dey kollect, bikos di pipol kon borrow from yu, one day, one pesin go kom kollect all yor propaty and e go sorry for poor pipol.
Pesin wey dey make money with wayo, bi like bird wey dey hash egg wey e nor lay. Wen e don dey old, e go luz all di money wey e get, den e go know sey e bi fool.”
Wen pipol dey sey, “Evritin dey okay and peaceful,” na dat time wahala wey go skata evriwhere go kom and e go bi like di pain wey woman dey face wen e won born and nobody go eskape from am.
Make yu give dis kommand to rish pipol. Tell dem sey, make dem nor dey karry body up kon dey trust dia money wey nor get value and make dem dey trust God wey dey give us evritin wey wi nid to take enjoy dis life.