12 bikos di Holy Spirit go tell una wetin to tok, wen dat time rish.”
God ask am, “Na who give man mout or na who dey make pesin fit tok, hear or si? Nor bi mi wey bi God?
Naw, make yu go and I go help yu tok kon tell yu wetin yu go tok.”
Make una nor worry about wetin una go tok wen dem drag una go kourt, bikos God go give una wetin to tok wen dat time rish.
Nor bi una go dey tok, but na una Papa Spirit go dey tok thru una.
Den one pesin among di pipol kon sey, “Tisha, tell my broda make e divide di propaty wey awa papa die leave for us.”
bikos I go give una di word wey una go tok and wisdom wey una enemy nor go fit oppoz.
Pita wey di Holy Spirit dey use well-well kon ansa, “Awa rulers and eldas,
But dis pipol nor fit stand di wisdom and pawa wey Stefen take dey tok.
But Stefen, wey God dey use well-well, look strait go heaven kon si God glory and Jesus Christ wey stand for God rite hand.