11 “Wen dem karry una go sinagog or go meet govnors and pipol wey get pawa to judge una kase, make una nor worry about how una go defend unasef or wetin una go tok,
I go send profets, wise pipol and law tishas kom meet una and una go kill and nail some for cross, flog some inside una sinagog, den porshu di odas from one town go anoda.
“So I tell una, make una nor worry about una life, wetin una go chop or drink and wetin una go wear for body. Life nor big pass food? Abi body nor betta pass klot?