Na only one tin I ask from God and dat na wetin I wont! Na make I stay for God house forever, so dat I go dey si en mighty works kon always dey happy for inside en temple.
I nor dey tok for sekret or for di dark place for di eart. I neva ever sey, ‘Jakob shidren just dey follow mi for nor-tin.’ Mi wey bi God dey tok di trut. Yes! I dey tok wetin dey rite.”
“Wish of di two shidren do wetin dia papa wont?” Dem ansa, “Na di first one.” Jesus kon tell dem, “I tell una true word, tax kollectors and ashawo dem go first una enter God Kingdom!
Nor bi una choose mi, but na mi choose una. Bikos of dat, I don give una pawa to bear fruit wey go last, so dat my papa go give una anytin wey una ask am for my name.
Jesus ansa am, “If yu know wetin God gift bi and di pesin wey dey ask yu for wota so, yu for ask am and e go give yu di wota wey dey make pesin live forever.”
Bikos E sey, “I hear una for di rite time and wen di day for Mi to save una rish, I help una.” Si, na di rite time bi dis; na naw bi di day for salvashon!
Nobody fit make belle sweet God without faith, bikos anybody wey dey kom meet am, must bilive sey, E dey alive and E dey reward pipol wey dey find am si.
But una wey dey Tiatira, wey nor dey follow wetin Jezebel dey tish (wey neva learn di tins wey dem dey koll “Satan deep sekret”), I dey tell una dis tins naw, but I nor go ask una for anytin again.