49 Na dis one make God tok with en wisdom sey, ‘I go send profets and apostles go meet dem and dem go sofa and kill some among dem.’
Since una grand-grand papa kom out from Egypt kon rish naw, I dey always send my savants, di profets kom meet una.
Di oda one seize di savants, beat dem anyhow and kill some.
Dis show sey una support di tins wey una grand-grand papa dem do, bikos dem kill di profets and una build dia graves!
and dem go use en name prish give pipol make dem for turn from dia sin kom meet God and di prishin go start from Jerusalem.’
Dem go drive una komot for di sinagog and di time dey kom wen di pesin wey go kill una, go tink sey e dey do God work.
but una go get pawa wen di Holy Spirit don enter una life and una go tell pipol about mi for Jerusalem, for evriwhere for Judea and Samaria go rish all di far place wey dey dis world.”
For di same time, some profets kon go Jerusalem from Antiok.
And wen dem kill yor savant Stefen, I stand der support dem kon keep dia koat for dem.’
But di pipol klose dia ear bigin shaut and all of dem kon rush am.
But Saul try to distroy di church; e dey go from house to house dey arrest men and wimen put for prison.
But for wi wey God don koll, weda wi bi Jew or Greek; na Christ bi God pawa and wisdom wey save us.
Una don bi Christ friends bikos of God and na thru Christ wi get wisdom, goodness and holiness wey kom from God;
Na Christ make some among us bi apostles, profets, evangelist, pastors and tishas.
Bikos all di wisdom and knowledge wey God get, E hide dem inside Christ.
Bikos dis pipol kill yor pipol and profets, so yu don give dem blood make dem drink, bikos na wetin good for dem bi dat!”
Evribody wey dey heaven, God pipol, di apostles and profets, make una happy bikos God don judge and kondemn am bikos of una!”