I go lead doz wey nor dey si, pass di road wey dem neva travel pass before. I go turn dia darkness to lite kon make rof road smooth for dem. Dis na wetin I promise and I go do dem; I nor go fail.
Den make una remember God kommand and evritin wey di profets sey go happen. True-true, all di pipol wey dey si vishon, dey tok all dis tins, bikos dia mind dey dark.
Den Jesus kom tell dem, “Anybody wey dey tisha di law and e bi disciple for God Kingdom, go bi like pesin wey get house kon bring new and old tins kom out from inside di house.”
Bikos God wey sey, “Make lite shine from darkness,” Na-im dey shine inside awa heart, so dat E go give us di lite wey show us en glory wey dey Christ face.
So make wi nor bi like shidren wey breeze dey karry up-and-down; shidren wey dey follow yeye tins wey human being dey tish and na dis tins dem dey take deceive pipol.
Make Christ word stay inside una and make una dey tish each oda with wisdom wey go make una heart strong. Make una dey sing psalms, hymns and spiritual song and dey do all dis tins to really tank God from una heart.
But di pesin wey dey look God pafet law wey dey free pipol; dey do wetin di word tok and e nor dey listin and forget, God go bless am for evritin wey e dey do.
But make una grow inside di grace wey awa Oga God and Savior, Jesus Christ give una, so dat una go know am more-more. Make glory bi en own, naw and forever! Amen.