35 So make sure sey wetin dey inside yu, na lite, nor bi darkness.
Wetin pesin dey do, fit dey good for en eye, but na deat dey end am.
Pesin wey foolish well-well, betta pass pesin wey tink sey e wise, but e nor get sense.
“Na eye bi di lite for pesin body. If pesin eye dey okay, lite go full en body.
Na eye bi di lamp wey body get. If yor eye well, lite go full yor whole body, but wen yor eye nor well, na darkness go full yor body.
If lite full yor body and darkness nor dey inside at-all, e go shine well-well like wen lamp dey shine for yor face.”
Even doh dem tink sey dem wise, dem bi fools;
But di pesin wey nor get dis tins, dey blind. Dis show sey, e nor dey si far and e don forget sey God don forgi-am en sins.
Dem dey use dia big-big grammar wey nor mean anytin, take deceive pipol wey just dey won komot hand for bad tins.
Bikos yu dey sey, “I get plenty money and I nor nid anytin!” But yu nor know sey yor kondishon bad well-well, yu dey sofa; yu poor; blind and naked.