Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 11:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 But wen pesin wey get pawa pass am attack and win am, di pesin go karry all di tins wey di man take dey protet ensef kon divide di propaty wey remain.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 11:22
14 Iomraidhean Croise  

I go make yu hate woman and yor pikin go still hate pikin wey woman born. Pikin wey woman born go mash yor head and yu go bite dia leg.”


Di enemies sey, ‘I go porshu, katch, divide dia propaty kon take evritin wey I wont. I go distroy dem with my swod.’


For dat day, God go use en great and pawaful swod take ponish and distroy Leviatan; dat dragon wey dey twist and waka fast-fast. Yes! God go kill di great monsta wey dey inside sea.


So, I go honor and put am for where great men dey, bikos na only en sakrifice en life and dem si am as sina too. E karry evribody sins for en head kon pray so dat God go forgive us.


“Wen pesin wey get pawa ready well-well guide en own house, all en tins go dey save.


“Anybody wey nor dey with mi, dey against mi and anybody wey nor dey work with mi, dey work against mi.


Make una wear komplete soja uniform wey God dey give, so dat una go fit stand fight di wayo wey devil dey use.


Na dis make mi sey, make una wear komplete soja uniform wey God dey give, so dat una go fit stand for groun wen trobol and wahala go kom and wen una don win, una go still stand well.


God disgrace wiked and evil rulers for publik, wen E win dem for di cross.


But pesin wey dey like to sin, na devil pikin, bikos devil dey sin from di biginnin. Na dis one make God Pikin kom dis world, so dat e go skata all di work wey devil dey do.


My shidren, una kom from God and una don get viktory ova doz pipol, bikos di pesin wey dey inside una, big pass di pesin wey dey di world.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan