10 Bikos pesin wey ask, go get, pesin wey find, go si wetin e dey find and di pesin wey nok, di door go open for am.
I kry to Yu as I dey fear kon sey, “Dem don take mi from Yu!” But Yu hear my kry for mesi kon ansa my prayer for help.
Den I kry kon sey, “I nor get respet again! I don lost evritin wey I hope to get from God!”
I kry well-well make E help mi, but God nor gri ansa mi.
Give pipol anytin wey dem ask from yu and nor drive anybody wey kom borrow sometin from yu.”
Anybody wey ask for sometin, go get am; anybody wey dey find sometin, go si wetin e dey find and pesin wey nok door, dem go open for am.
“Wish of una wey bi papa go give en pikin snake, if e ask for fish?
“So, I tell yu true word: Make yu ask and God go give yu, find and yu go si wetin yu dey look for, make yu nok and di door go open for yu.
Den Jesus tell dem one parabol to show sey, e good make pipol dey always pray.
Wen yu ask for sometin, yu nor receive am, bikos yu nor ask well and yu won take am do wetin yu like.
Make una tink of how wi dey look pipol wey get patient sey, God don bless dem. Una hear how Job get patient and how God bless am leta. God get mesi and E dey sorry for pesin well-well.