Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 10:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 and heal di pipol wey nor well for dat town, den tell di pipol wey dey der sey, ‘God Kingdom don kom meet una.’

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 10:9
15 Iomraidhean Croise  

For di time wey dis kings go dey rule, God wey dey heaven go raiz one kind kingdom wey nor go ever end. Dem nor go fit distroy di kingdom and anoda pesin nor go rule am. E go distroy and skata all di oda kingdoms. But dis kingdom go stand forever.


“Make una turn from sin kom meet God, bikos God Kingdom don near.”


From dat time, Jesus bigin prish sey, “Make una turn from sin kom meet God, bikos God Kingdom don kom meet una.”


Jesus kon ask dem, “Wetin wi go take kompare God Kingdom? Wish parabol wi go fit use take show as e bi?


Dem drive many demon komot from pipol body and pour oil for many pipol wey nor well head kon heal dem.


But wen una enter any town and dem nor welkom una, make una go road kon sey,


‘Even di san for una town wey dey awa leg, wi shake am komot make e bi witness against una. But make una know sey: God Kingdom don kom meet una.’


Den e kon send dem go prish about God Kingdom and heal pipol wey nor well.


Jesus tell am, “Make I tell yu true word, unless dem born pesin di sekond time, e nor go fit si God kingdom.”


Jesus ansa am, “I tell yu di trut, unless God born pesin with wota and en Spirit, di pesin nor go fit enter God kingdom.


“So make una know sey, dis salvashon wey God bring, dem don karry am go meet Gentile pipol, bikos dem go asept am!”


kon dey tell dem about God Kingdom. E tish dem with strong heart about Oga God Jesus Christ and nobody fit stop am.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan