Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 10:39 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

39 Mary, wey bi Marta sista, sidan near Jesus leg dey listin to wetin e dey tish.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 10:39
11 Iomraidhean Croise  

Elisha go Gilgal and betta honga dey di land. Di profets sons sidan round am. E kon tell en savant, “Make yu put big pot for fire kon make food for dis pipol.”


Make blessing follow di pesin wey dey listin to mi. Evriday, e dey wosh my gate and dey wait mi outside my house.


na only one tin dey important and Mary don choose di korrect tin and nobody go fit take am from am.”


Afta three days, dem kon si am inside di temple, where e sidan with di tishas dey listin and dey ask dem many kweshon.


So pipol run kom si wetin dey happen and dem meet Jesus for der. Di man wey Jesus drive demon komot for en body, don well and e wear klot sidan near Jesus leg, so fear kon katch di pipol.


E get one man, en name na Lazarus and e nor well. En with Mary and Marta, en sistas kom from Betany.


and from der, many Jew pipol kon salot Mary and Marta, bikos of dia broda wey die.)


Mary take perfume wey dear well-well, wey plenty rish kwota gallon kon pour am for Jesus two leg. Den e use en hair take klean dem. (Di perfume send kon full evriwhere for inside di house).


“I bi Jew wey dem born for Tarsus wey dey Silisia, but na for dis town I for grow, I go skool and learn awa grand-grand papa dem law well-well under Gamaliel and I get mind to serve God well-well, just as una bi today.


Yes! God really love en pipol; all doz wey dey holy dey en hand. Dem waka as E dey waka kon do di tins wey E tish dem.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan