Make yu nor forget yor friends or yor papa friends, bikos if yu dey trobol, yu nor nid to ask yor relashon for help. Di neighbour wey dey near yu, fit help yu pass yor relashon wey dey far.
E waka go meet di man kon rob wine and olive oil for en sore and bandage am. Den e put di man on-top en horse kon karry am go one hotel and e kare for am dat nite.
Den di woman kon tell Jesus, “How yu wey bi Jew kon dey ask mi wey bi Samaria pesin, sey, ‘Make I give yu wota drink?’ ” (E tok dis one bikos Jew and Samaria pipol nor dey gri at-all.)