Na Yu bi di hope wey Israel get; so make Yu disgrace doz wey leave Yu. Make dem disappear like name wey dem rite for san, bikos dem forget Yu wey bi di spring wey dey bring fresh wota.”
I go soon ponish una wey bi lie-lie profets, bikos wetin una dey tok, dey skata pipol. Una nor go dey der wen my pipol go gada make decision; una name nor go dey among Israel pipol and una nor go ever kom back to di land. Den una go know sey na mi bi God.
“Den Mikael; di great prince wey dey guide yor pipol, go appear. Dat na wahala time and dis kind wahala neva happen for anywhere kom rish naw. But yor own pipol wey dia name dey di book wey get life, go eskape.
Yes, my good friends, I still dey tell una, make una help dem. Dem try as dem dey prish di gospel with mi, both Klement and my oda ko-workers, wey dia name dey inside Christ Life Book.
di place where all di first-born gada and dis na di pipol wey God rite dia name for heaven. Una don kom meet God wey go judge evribody and na-im dey make pipol pafet.
Di beast wey yu si, dey before, but e nor dey again and e go soon raiz kom from di pit kon start to distroy. Den doz pipol for eart wey dia name nor dey for di Life Book, go fear di beast.
And I si di pipol wey don die, both big and small, as dem stand for di throne front. Dem open plenty books and den kon open anoda book wey bi di Life Book. And dem judge doz wey don die akordin to wetin dem rite for di books sey dem do.
But know dirty or yeye tin go ever enter di town. Pesin wey dey do bad or dey lie, nor go ever enter der, but di pipol wey go enter, na only doz wey dem rite dia name for di Lamb Life Book.
Anybody wey fit bear rish di end, go wear white klot like dem and I nor go remove en name from my Life Book, but I go tok about am for my Papa and en angels front.