Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 10:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 Di seventy-two men kon kom back with happiness, dey sey, “Oga God, even demons dey obey us wen wi kommand dem with yor name!”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 10:17
8 Iomraidhean Croise  

So di news about Jesus kon spread go evriwhere for Siria. Dem kon bring pipol wey nor well, wey nor fit waka, pipol wey devil dey worry and di pipol wey demon dey inside dem, kom meet am and e heal all of dem.


Dis signs go follow pipol wey bilive: With my name, dem go drive demon komot from pipol body; dem go speak new language wey dem nor learn;


Afta, Jesus choose seventy-two men kon send dem two-by-two go all di town and oda place where e won go leta.


Make una nor only dey happy sey evil spirit dey obey una, instead make una happy sey God rite una name for heaven.”


and heal di pipol wey nor well for dat town, den tell di pipol wey dey der sey, ‘God Kingdom don kom meet una.’


Afta Jesus don koll di twelf disciples togeda, e give dem pawa and authority to drive demon and to heal pipol wey nor well.


And God wey dey give peace, go soon distroy Satan for una. Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with una.


As di church dey submit to Christ, na so too, wife suppose submit to dia husband for evritin.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan