God sey, “Tyre pipol don too sin, but I go ponish dem naw, bikos dem sell a whole kountry as slave give Edom pipol and dem nor gri keep di agriment wey dem make with Israel.
“E nor go betta for Korazin and Betsaida pipol! If to sey di mirakles wey dem do among una happen for Tyre and Sidon, dem for don turn from dia sin kom meet God, kon karry ashes put for head and wear tear-tear klot,
Na dis bi di rizin why God go judge di world, bikos lite don kom inside di world, but pipol like to stay for darkness instead of lite, bikos dem dey do tins wey nor good.
Pesin wey dey judge odas nor get eskuse for wetin e dey do and e nor matter who en bi. Bikos wen yu judge odas and yu dey do di same tin wey dem dey do, yu dey kondemn yorsef.