10 But wen una enter any town and dem nor welkom una, make una go road kon sey,
Weda dem listin to yu or not, dem go know sey one profet don kom meet dem.
If di pipol nor welkom or listin to una message, make una shake dia san komot from una leg as una dey leave dat house or town.
‘Even di san for una town wey dey awa leg, wi shake am komot make e bi witness against una. But make una know sey: God Kingdom don kom meet una.’
and heal di pipol wey nor well for dat town, den tell di pipol wey dey der sey, ‘God Kingdom don kom meet una.’
Anywhere wey dem nor welkom una, make una shake di san from una leg as una dey komot and dis go bi witness against dem.”
So wen dem don shake di land san-san wey dey dia leg komot, dem kon go Ikonium.
Wen dem oppoz and curse am, e shake en dress kon sey, “Make una blood dey una head, bikos I nor do any bad tin and from today go, I go-go prish for Gentile pipol!”