Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 1:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 and as dia custom bi, dem kon choose Zekaraya make e enter inside God Temple go burn incense.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 1:9
10 Iomraidhean Croise  

Na Amram born Aaron and Moses. Dem choose Aaron and en shidren-shidren to dey kare for di holy tins; burn incense to take woship God; to dey serve God and dey bless di pipol with God name forever.


Na Aaron and en shidren-shidren dey offa sakrifice for God altar. Na dem dey kare for di holy place and for all di sakrifice wey go make God forgive Israel pipol dia sins. Dem do all dis tins, just as Moses kommand dem.


E kon use en pawa take distroy ensef, bikos e nor gri obey God again. E enter God Temple kon offa incense for di altar.


My pipol, make una nor waste time, bikos God don choose una to serve and gi-am sakrifice.”


Dis na warnin to Israel pipol sey, “Anybody wey nor kom from Aaron family, nor go fit burn incense to God for di altar. If not, e go die like Korah and en men.” All dis happen akordin to wetin God kommand Eleazar thru Moses.


So Judas kon trow di silva koins inside di temple, den e komot go hang ensef.


Wen all dis tins don ready, di priests dey enter di first room evriday go do dia work.


From all di tribes for Israel, I choose una grand-grand papa Aaron family to bi priest, so dat dem go serve and burn incense for mi, den kon wear di priest garment for my present. And I give dem di rite to take some from di sakrifice wey pipol dey burn give mi.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan