Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 1:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 E kom rish Zekaraya family turn to do priest work for di temple

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 1:8
16 Iomraidhean Croise  

Dis na how dem take do dia work wen dem enter God Temple and na akordin to di rules wey dia grand-grand papa Aaron give dem, just as di Oga wey bi Israel God, kommand am.


Nadab and Abihu die before dia papa die and dem nor born pikin, so dia brodas, Eleazar and Itama kon bi priest.


Levi pipol leave all dia propaty and betta land kon kom Judah and Jerusalem, bikos Jeroboam with en shidren nor gri make dem serve as God priest.


Dem choose some men from di priests from Aaron shidren-shidren towns, so dat dem go share di food give all di priests and doz for Levi family rekord.


King Hezekaya put priest and Levi pipol sey make dem dey burn sakrifice, serve, give ofrins, tank, praiz and dey woship God for en temple.


As en papa David tok, Solomon choose difren priests to do difren tins. E choose Levi pipol wey go dey lead woship and help di priest for dia work evriday and doz wey dey guide di gate. Dis na wetin David, God savant tok.


Dem still arrange di priests and Levi pipol wey go dey serve for di temple for Jerusalem, just as dem rite am for Moses Law.


“Yu go separate yor broda Aaron and en sons; Nadab, Abihu, Eleazar and Itama from Israel pipol so dat dem go serve mi as priest.


Yu go wear dem give Aaron yor broda and en sons. Yu go anoint, klean and santify dem, so dat dem go fit serve as my priests.


“Dis na how yu go take dedikate Aaron and en sons as my priest. Yu go take one yong melu and two ram wey dey okay.


I go santify di tent where dem for dey do meetin, di altar, Aaron and en sons, so dat dem go fit serve mi as priest.


Put sash round dia waist kon wear head-band for dem, so dat dem go serve as priest, just as God kommand dem. Na so yu go take klean Aaron and en sons.


Yu go anoint and santify Aaron and en sons, so dat dem go fit serve as my priest.


But na yu and yor sons go do di priest work, evritin wey dey di altar and di Holy Place. And yu must work, bikos I don give yu di gift to bi priest and anybody wey I nor choose, if e kom near di holy tin, dem must kill-am.”


For di time wen Herod bi King for Judea, one priest dey wey en name na Zekaraya from Abijah family and en wife name na Elizabet, wey kom from Aaron family.


Dem nor get pikin, bikos Elizabet nor fit get belle and dem don old well-well.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan