Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 1:78 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

78 Since God love and en kindness strong well-well, E go let en salvashon rish us,

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 1:78
19 Iomraidhean Croise  

My God, remember yor kindness and love wey nor dey fail, wey Yu dey show us, since awa grand-grand papa time.


For dat time, one pesin go kom from Jesse family. Yes! One rut go grow kom out from David house.


I go lead doz wey nor dey si, pass di road wey dem neva travel pass before. I go turn dia darkness to lite kon make rof road smooth for dem. Dis na wetin I promise and I go do dem; I nor go fail.


Oga God! Make Yu look us from heaven, yor holy place where Yu dey stay wey get glory. Where yor pawa and strong mind dey? Where yor love and mesi dey? Make Yu nor leave us at-all.


I go tok about God love wey nor dey fail. I dey praiz am for wetin E don do for us. E don bless Israel pipol well-well, bikos of en mesi and love wey nor dey fade.


Joshua di High Priest and all di priests, make una listin to mi, na una bi my sign about wetin go happen; bikos I go soon bring my savant, wey bi di Branch!”


Make yu tell am, ‘God wey get pawa sey, “Dis na di man wey dem dey koll di Branch, e go prosper kon build God temple again.


But for una wey dey fear my name, my sun wey dey give life go shine and heal una. Una go dey free kon dey happy like melu pikin wey dem open en kage make e for go play.


‘I don si am, but nor bi naw e go happen; Even doh I hold am, e nor dey near my hand. One star go kom out from Jakob pipol. E go kom out from Israel like septa. E go kill Moab pipol and Seth sons.


“God love di pipol wey dey dis world well-well, so E kon send di only pikin wey E get to us, so dat anybody wey bilive am, nor go die, but e go get life wey nor dey end.


Bikos na lite dey make evritin shine kom out and na dis make dem rite sey: “Wake-up; yu wey dey sleep! Make yu raiz from grave and Christ go shine for yor life!”


God know sey, bikos of Christ love wey dey my heart, I dey miss una well-well.


Gain dey to serve Christ? Konfort dey for en love? Fellowship dey between pipol and God Spirit? Una heart good rish to show pipol mesi?


So, as pipol wey God don choose, wey holy and wey E love well-well, make una kwik dey sorry for pipol; dey gentol; nor dey karry body up and wear patient like klot for body.


Afta dat one, wi bilive wetin di profets prish. Una go do well if una hear and follow di lite wey dey shine for darkness and wen day break, di star wey dey kom for morning, go shine for una heart.


But pesin wey get enough tins and e nor sorry for en broda or sista for Christ wey nor get at-all, na how God love go take dey inside am?


“Mi, wey bi Christ, I don send my angel make e kom tell di pipol for di church di trut about dis tins. I kom from David family and na mi bi di brite Star wey dey shine for morning!”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan