Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 1:75 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

75 and wi go dey holy and good for en eye as long as wi dey for dis world.’

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 1:75
19 Iomraidhean Croise  

Na mi form dis pipol for mysef and dem go sing praiz mi!”


“Di fasting wey Judah pipol dey do for di fourt, fift, sevent and tent mont, go kon bi festival for joy and for betta tins. Una must love trut and peace.”


E go born boy and yu go koll am ‘Jesus,’ bikos e go save en pipol from dia sin.”


‘E go save us from awa enemy hand, so dat wi go fit take all awa heart serve am


Before God kreate di world, E choose us thru Christ bikos E love us, so dat for en front, wi nor go get any fault and wi go dey holy.


God kreate us thru Jesus Christ as di good work wey E don prepare down before, so dat wi go dey do as E plan.


Den, true raitiousness and holiness wey di trut dey bring, make una wear di new man wey God don kreate like ensef.


Una go make sure sey una respet Oga God and obey all en statutes and kommandments wey I dey give una – una, una shidren and grand-shidren – go obey am with all una life so dat una go get long life.


Finally, my brodas and sistas, wi dey ask and beg una bikos of Christ sey, as una don hear from us about how una suppose live as God wont (as una dey do naw), make una kontinue to dey live like dat.


Bikos God nor koll us to live yeye life, but na to live holy life.


But my brodas and sistas wey God love, wi dey always tank God for una evritime, bikos God don choose una from di biginnin sey, E go save una with di Holy Spirit pawa wey go make una dey holy, since una get faith and trut.


Bikos God save and koll us to live holy life. E do like dis, nor bi sey wi deserve am bikos of wetin wi do, but na so E plan am even before di world start, so dat wey go know en grace thru Jesus Christ.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan