Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 1:68 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

68 “Make wi praiz Israel God, bikos E don help and free en pipol.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 1:68
24 Iomraidhean Croise  

Make all praiz bi di Most High God own, di one wey diliver yor enemies put for yor hand.” Abram kon give Melkizedek one out of evry ten tin wey e bring kom back from di war.


E kon sey, “Make praiz bi God own, my oga Abraham God, bikos Yu don show mi yor love wey nor dey fail and as Yu dey good to my oga family.”


E still sey, “Make wi praiz God wey bi Shem God and Kanaan go bi en savant.


kon pray sey, ‘Make wi praiz di Oga wey bi Israel pipol God, wey don make one of my pikin take my place as king and E make mi dey alive to si am!’ ”


E sey, “Di Oga wey bi Israel pipol God, make all di praiz bi en own! E don do wetin E promise David my papa, wen E tell am sey,


For der wey all di pipol gada put, David praiz God kon sey, “God wey awa papa Jakob serve, wi praiz yor name forever!


Den David kommand en pipol, “Make una praiz di Oga wey bi una God!” And all di pipol praiz di Oga wey bi dia papa God kon bow honor en and di king.


Make wi praiz di Oga wey bi Israel God wey dey alive forever and ever! Make all di pipol sey, “Amen!”


E diliver en pipol kon make sure sey en kovenant go dey forever. Make una si as en name dey holy and big!


E go diliver Israel pipol from di wahala wey dem dey face, bikos of dia sins.


So make una praiz di Oga wey bi Israel God, bikos E dey alive forever and ever. Amen!


so di pipol bilive Moses. Wen dem hear sey God don kom save Israel pipol and E don si as dem dey sofa rish, dem kon bow woship am.


sey, wi go dey save from awa enemy and from pipol wey hate us.


Dem go distroy una and una shidren and dem nor go leave one block on-top anoda, bikos di time wen God kom visit una, una nor know.”


For dat time, e kom meet Josef, Mary, di pikin and Simeon kon bigin tank God, dey tok about di pikin give evribody wey dey wait for di time wen God go free Jerusalem.


But wi bin hope sey naim go free Israel and dis tins don happen for three days naw.


Fear katch all of dem and dem kon dey praiz God sey, “Na big profet kom meet us so-o!” and “God don kom help en pipol!”


I bless God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa; wey don bless us with difren spiritual blessing from heaven, bikos of Christ.


Na thru Christ blood wi take get salvashon and na dis blood make God dey forgive us awa sins, bikos en grace big well-well.


Na wons Jesus enter di place wey holy pass. E nor enter with goat or ram blood, but na with en own blood, so e don save us forever and ever.


Wi tank God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa, for di mesi wey E dey show us. God give us new life thru Jesus Christ wey E wake from deat and naim bi di Pesin wey give us hope.


Den David kon tell Abigail, “Make wi praiz di Oga wey bi Israel God wey don send yu kom meet mi today!


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan