60 But en mama sey, “No, dem must koll am John.”
and E kommand Profet Natan make e koll am Jedidaya, bikos God love am.
So afta sometaim, my wife kon get belle. Wen e don born awa son, God kon tell mi, “Make yu koll am, ‘Kwik karry Make Yu Distroy Fast-fast.’
but e nor sleep with am until Mary born di pikin. Den e kon name am, Jesus.
But di angel tell am, “Make yu nor fear Zekaraya, bikos God don hear yor prayer. Yor wife Elizabet go born boy pikin for yu and yu go koll am, ‘John.’
Dem kon sey, “But e nor get any of una relashon wey en name bi John.”
Zekaraya ask for sometin make e rite put, den e kon rite, “En name na John.” So, all of dem kon sopraiz well-well.