So God make kovenant with Abraham thru sekonsishon. Abraham kon born Isaak and sekonsaiz am afta eight days. Isaak born Jakob and Jakob born di twelf brodas, wey bi awa grand-grand papa dem.
Dem sekonsaiz mi eight days afta dem born mi. I kom from Israel, Benjamin tribe and I bi Hibru man. I bin dey live akordin to di law, bikos I bi Farisee.