Di ofrin smell kon make belle sweet God, so E tell ensef, “I nor go ever curse di eart again, bikos of wetin human being do; even doh I know sey since wen I kreate dem, na only bad tins dem dey tink. I nor go ever distroy evritin wey get life as I don do so.
Oga God, make Yu raiz-up kon help us! Save us with yor pawa. Make Yu use yor pawa, just as Yu dey do before. Di monsta wey dem dey koll Rahab wey dey di sea, na Yu kut am to pieces.
Naw, mi Nebukadnezzar praiz, woship and hail di King wey dey heaven. Evritin wey E dey do dey rite and en ways dey pure. Pipol wey dey karry body up, E dey bring dem down.
Even doh dem know sey God dey, dem nor dey gri gi-am glory as God. Dem nor dey tank am for all di tins wey E dey do. Instead, na nonsense tins dem dey do and dia wiked mind nor fit undastand di trut again.
Or God don ever try to diliver one kountry from anoda kountry with judgement, signs, wonders, war, strent, pawa or any oda tin wey dey make pesin fear like di ones wey God do for Egypt for una own eyes?
For di same way, make una wey yong put body down for di eldas. Make una nor dey karry body up for each oda, bikos God dey oppoz proud pipol, but E dey favor doz wey dey honbol.
Bikos of dis, na one day God go ponish am for all en sin with diziz, mourning, honga and dem go burn am with fire, bikos na Oga God wey go judge am, get all di pawa!”