50 E dey show en mesi to evribody wey dey fear am for evry generashon.
“I go keep my promise wey I make with yu and to yor shidren-shidren, di kovenant go always dey forever. I go bi yu and yor shidren God.
Make una woship di Oga wey bi una God; den E go save una from all una enemies.”
As di sky high from di eart, na so too en love for pipol wey dey fear and serve am, big rish.
E go bless di pipol wey dey obey am; both small and big.
Make evribody wey dey fear God sey, “En love dey-dey forever.”
Pipol wey dey fear am, E dey give dem wetin dem wont; E dey hear wen dem dey kry for help kon save dem.
No! But God dey happy for pipol wey dey fear and obey am; doz wey put dia hope for en love wey nor dey fail.
Si as yor favor great rish; di one wey Yu keep for doz wey dey fear Yu. Yu dey pour dem on pipol wey kom make Yu protet dem and Yu dey bless dem for evribody front.
True-true, time dey kom wen pipol wey dey follow am well, go si en salvashon; den en glory go appear for di land again.
But I go show my love to many generashon, bikos dem love and keep my kommand.
bikos E don do big-big tins for mi and en name dey holy.
Den one vois tok from di throne sey: “Wi wey bi God savant, make wi praiz am! All of una wey dey fear am, both small and big, make una praiz am too!”