Na mi bi di high and holy God, di Pesin wey go live forever. Where I dey stay, dey high and holy, but I still dey stay with pipol wey dey honbol and ready to turn from sin kom meet mi, so dat I go give dem mind and hope again.
“Who bi dis pesin wey dey kom from Bozrah wey dey Edom? Who wear fine red klot dey waka kom with pawa and strent?” Na mi God wey dey speak with raitiousness, wey dey mighty and get pawa to save.
But God wey strong and get pawa, dey my side. So doz wey dey plan against mi, go fail. Yu go disgrace dem forever, bikos dem nor go susid and dem nor go ever forget di disgrace.
So Jesus kon allow dem. So di evil spirit kom out from di man kon enter di pig dem. Den di pig dem run pass one low place enter di river and dem rish 2,000 wey die inside di wota.
Each for di for creatures get six feada and eye full di feadas. Dem nor dey ever rest for nite or day and dem dey always sey: Holy! Holy! Holy! Na-im bi di God wey dey mighty. Di Pesin wey dey since, wey dey naw and wey go soon kom.