Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 1:46 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

46 Mary kon sey, “My heart go praiz God

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 1:46
15 Iomraidhean Croise  

Den I go happy, bikos of my God. I go happy, bikos E save mi.


Dem go bless and praiz Israel pipol, bikos of di Oga awa God.”


Jerusalem pipol dey happy, bikos of wetin God don do. E bi like yong woman wey dem dress ready for marriage. God don wear salvashon and viktory klot for en body.


Nor bi only dis won make us dey happy, but wi still dey happy bikos of wetin God don do thru awa Oga God Jesus Christ wey make us bi God friends.


bikos, God word sey, “Anybody wey won boast, make e use Christ take boast.”


But make wi tank God wey make us winners inside Christ. Bikos thru us, many pipol don know tins about Christ, like betta perfume wey dey smell for evriwhere.


Na wi bi di really sekonsishon; di pipol wey dey woship God thru en Spirit; pipol wey dey happy inside Christ and wi nor dey put awa hope for wetin pipol dey do.


Make una always dey happy inside Christ. I dey tok again sey, make una dey happy!


Make God wey dey give peace, help una to dey holy go rish di end, so dat for di day wen Christ go kom, una spirit, soul and mind go dey without fault.


Aldo una neva si am, but una love am. Una nor dey si am naw, but una bilive am, una get happiness and glory wey una nor go fit esplain.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan