den one among David shidren-shidren go bi king and e go rule di pipol with en whole heart and love. E go dey do wetin dey rite and e go make sure sey dem nor opress anybody again.”
En royal pawa go kontinue to grow. En kingdom go get peace forever. E go rule well like King David kon do betta tins with en pawa; e nor go opress pipol and E go rule from naw go rish wen di world go end. God Almighty go do all dis tins.
God sey, “Di time dey kom wen I go choose betta king from among David shidren-shidren. E go rule di land with wisdom kon do wetin dey korrect and good.
For di time wey dis kings go dey rule, God wey dey heaven go raiz one kind kingdom wey nor go ever end. Dem nor go fit distroy di kingdom and anoda pesin nor go rule am. E go distroy and skata all di oda kingdoms. But dis kingdom go stand forever.
But wen di seven years don pass, mi, Nebukadnezzar kon look heaven and my sense kom back to mi. I praiz di Most High God kon give honor and glory to di Pesin wey dey live forever and en kingdom go last forever.
I dey kommand sey, ‘Make evribody wey dey dis kingdom, fear and respet only Daniel God.’ “E go rule forever, bikos E nor dey die. Dem nor go fit distroy en kingdom and en pawa nor get end.
Doz wey dey weak, go survive and doz wey bi slave and prisonas for anoda kountry, go kon bi one strong nashon. Den mi wey bi God go rule Jerusalem as dia king forever.”
Na wi bi di really sekonsishon; di pipol wey dey woship God thru en Spirit; pipol wey dey happy inside Christ and wi nor dey put awa hope for wetin pipol dey do.
Di sevent angel blow en trumpet and one loud vois kon shaut from heaven: “All di kingdom for di world don bi God and Christ own. E go rule forever and ever.”