29 But Mary dey fear, bikos of wetin di angel tok and e bigin wonder wetin di greetin mean.
So dem kon dey tok among demsef sey, “Na bikos wi nor bring bread, naim make am dey tok like dis.”
As Zekaraya si di angel, fear katch am well-well and e kon dey shake.
Di angel kon tell am, “I salot yu o-o! Yu wey God don favor, bikos E dey with yu.”
So evribody wey hear wetin happen, keep am for dia mind dey sey, “Wish kind pikin dis one go bi sef?” Bikos God dey with am true-true.
But Mary keep wetin e hear for en mind kon dey tink about am.
Den Jesus follow dem go Nazaret kon dey do wetin dem tell am. But en mama keep all dis tins for mind.
As Pita still dey wonder wetin di vishon mean, di men wey Kornelius send kon rish Simon house.
Fear katch am as e dey look di angel, so e ansa, “Oga God, Wetin yu wont?” Di angel tell am, “God don hear yor prayer and si all di good tins wey yu dey do for poor pipol.