So, God go give una sign by ensef. One yong woman wey neva ever sleep with man before, go get belle kon born boy pikin and dem go koll am, ‘Immanuel, wey mean, “God dey with us.” ’
Pipol wey nor bilive, na wen una go stop to waste una time? Mi wey bi God promise to bring new tin kom dis eart and e go dey special like wen woman dey protet man.”
Dis na how dem take born Jesus Christ. Wen Mary en mama don ready to marry Josef, before dem bigin sleep togeda, Mary kon si sey e don get belle with Holy Spirit pawa.