26 Wen Elizabet belle don rish six monts, God kon send angel Gabriel go Nazaret, one small town for Galilee,
Den I hear vois from Ulai river dey sey, “Gabriel, make yu tell am di meaning of wetin e si.”
Angel Gabriel wey I don first si for my vishon before kon dey fly kom where I dey. Dat time, dem won offa di evening sakrifice.
Wen e rish Nazaret, e kon stay der. Dis one make wetin Profet Jeremaya tok happen sey, “Dem go sey Jesus, na Nazaret e from kom.”
Di angel ansa, “I bi Gabriel, wey dey stand for God present and na-im send mi kom tell yu dis Good News.
So, wen Josef and Mary don do all di tins wey God law sey make dem do, dem kon go back to dia house for Nazaret for Galilee.
So Josef wey dey stay for Nazaret for Galilee kon travel go Betlehem, David Town for Judea, bikos na David family e from kom.
Some still sey, “Na-im bi di Christ”, but odas sey, “Na lie, Christ nor fit kom from Galilee.