and dat ofisas bin ansa sey, “E nor fit happen, even if God ensef go send korn kom naw-naw!” And Elisha tell am, “Yu go si am dey happen, but yu nor go ever chop from di food.”
One of di king ofisas ansa, “Abeg. Dat nor fit happen! Even if God ensef dey drop food from heaven, e nor go fit happen!” Elisha ansa, “Yu go si am dey happen, but yu nor go ever chop from am!”
Na Samaria bi Israel main town and na King Pekah dey rule am. So if yu nor gri bilive or trust and put yor hope for God hand, den yu nor go fit stand and yu go really die.”
Dat same day, yor mout go open and yu go fit tok again. Yu go tok to di pesin wey eskape kom and dis go bi sign to di pipol, den dem go know sey na mi bi God.”
Den God tell Moses and Aaron, “Bikos una nor trust mi well-well to show di pipol how I dey holy rish, una nor go take dem enter di land wey I dey give una.”
God nor dey lie! So di promise wey E make and ensef wey E take swear, na two tins wey nor go shange. Since wi don run go meet God make E guide us, e good make awa mind strong, so dat wi nor go fear as wi bilive en promise.