But en papa sey, “My pikin, I know; I know wetin I dey do. Manasseh too go bi strong nashon and e go dey great. But even with all dis, en yonga broda go strong pass am and en shidren-shidren go many like san-san.”
“Before I put yu for yor mama belle, I don know and choose yu. I don selet yu, before dem even born yu. Yes! I don choose yu as my profet and yu go take my message go evriwhere.”
“Make yu and yor sons nor drink wine or strong drink wen una enter di tent, so dat una nor go die and dis na law wey yu and yor shidren-shidren must obey.
Oga God wey get pawa go protet en pipol and dem go distroy dia enemies. Dem go dey shaut for war like who drink dey katch and dem go kill dia enemies finish. Dia enemies blood go plenty well-well like sakrifice blood wey dem pour put for di altar.