12 As Zekaraya si di angel, fear katch am well-well and e kon dey shake.
Na only mi, Daniel si di vishon. Di men wey follow mi nor si am. Dem run go hide, bikos dem dey fear.
As dem enter, dem si one man wey wear white klot sidan for di rite side and fear kon katch dem.
But Mary dey fear, bikos of wetin di angel tok and e bigin wonder wetin di greetin mean.
Fear katch am as e dey look di angel, so e ansa, “Oga God, Wetin yu wont?” Di angel tell am, “God don hear yor prayer and si all di good tins wey yu dey do for poor pipol.
Wen I si am, I fall near en leg like sey I don die. But E tosh mi with en rite hand, kon sey: “Nor fear! Na mi bi di First and di Last,
Manoah tell en wife, “Wi go die, bikos wi don si God!”
Gideon bigin kry, wen e kon know sey na God angel bi dat, den e sey, “My Oga God wey get pawa, I don si yor angel face-to-face!”