6 Den Moses tell dem, “Dis na wetin God kommand una to do, so dat di lite wey dey shine for en present, go appear to una.”
As Aaron dey tok to Israel pipol, dem turn look di wildaness kon si God glory wey appear inside di kloud.
God glory dey on-top Mount Sinai and di kloud kover am for six days. For di sevent day, God kon koll Moses from inside di kloud.
I go meet Israel pipol for der too, bikos my present wey karry glory don make am holy.
and I kon si Israel God glory dey kom from di east. God vois sound like nois from sea and en glory shine kover di eart.
Moses and Aaron enter di tent and wen dem kom out, dem kon bless di pipol, den di lite wey dey shine for God present kon appear to di pipol.
So dem take evritin wey Moses kommand go di tent front and di whole kommunity gada for der kon woship God.