12 E kill di animal wey dem won use for burnt ofrin. En sons karry di blood gi-am and e rub am for di four side for di altar.
Aaron ansa, “If I chop di sin ofrin today, God go happy with mi? Bikos even doh di pipol give God dia sin and burnt ofrin today, all dis bad tins still dey happen to mi.”
But e burn di meat and di skin for outside di kamp.
Dem give Aaron di head and di oda pieces for di animal and e burn dem for di altar.
E still bring di animal for di burnt ofrin kon gi-am akordin to di law.
En sons karry di blood gi-am, den e shuk en finger put kon put am for di horn wey dey di altar and e pour di remainin ones under di altar.
Make wi love one anoda, just as Christ love and sakrifice ensef as ofrin wey get betta smell to God, bikos of us.