Out of all di ofrin wey holy well-well wey dem nor put for fire, dis go bi yor own: evry ofrin wey bi dia own, weda na from dia korn ofrin or from dia klean ofrin, or evry ofrin wey dem give mi, go dey holy well-well for yu and yor sons.
Una nor know sey doz wey dey work for di temple dey chop food wey pipol bring kon give God for der? Abi una nor know sey pesin wey dey serve for altar na from der e for dey chop?