Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Levitikus 7:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 “If anybody bring peace ofrin to take pay en vow or e do am from en mind, nor bi all of dem una go chop di day wey e gi-am, but dem fit chop di remain wons for di next day.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Levitikus 7:16
17 Iomraidhean Croise  

I go keep my promise wey I make to God for en pipol present.


Na for pipol present I go for do wetin I vow to God


I go enter yor temple with sakrifice; I go do di tins wey I promise Yu;


Nobody force Israel pipol as dem dey give dia ofrin to God. Evry man and woman bring as en heart move am to bring, so dat dem go take am do all di work wey God kommand dem thru Moses.


“I get fresh meat for house and today, I don do wetin I promise.


Wen di prince won kom just give God ofrin from en mind, weda na burnt or fellowship ofrin, dem go open di east gate where dem dey pass enter di kourtyard, for am. E go give di ofrin just as e dey offa am for Sabat Day and wen e don go out, dem go must klose di gate.”


Una fit offa animal wey short or wey neva mature as ofrin from una mind, but I nor go asept am if una use am take pay for una vow.


Wen una dey offa tanksgivin sakrifice to God, una must follow di rule, so dat I go asept am from una.


Dis festival join di normal Sabat Day and dis ofrin dem join di normal gift ofrin. Dis na ofrin to take do una vow and di ones wey una give God from una mind.)


Si! One messenja dey from di mountin kom give una good news! E dey bring peace message kom. So my pipol for Judah, make una celebrate kon do wetin una promise, bikos una wiked enemies nor go ever enter una land again and God go distroy dem finish.


make una give mi one melu, one ram, one sheep or goat as burnt ofrin. Nor bi sakrifice to pay una vow or free will or first ofrin; put na ofrin wey God like en smell,


una must bring evritin wey I kommand una: una burnt ofrin; sakrifice ofrin; tithe and vow ofrin kom di place wey God choose as where dem go for woship and honor en name.


But make una nor chop ofrin for una own town or tithe for una harvest and for una first fruit or animal, or sakrifice ofrin and vow ofrin.


But make una take di holy ofrin and di vow wey una make, go di place where God choose.


For der, una go karry burnt ofrin, sakrifice, vow ofrin, ordinary ofrin and una ofrin for di first fruit and animals wey una get.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan