I dey keep my promise to tazon generashons. I dey forgive evil and sins. But I nor go fail to ponish wiked pipol with dia shidren-shidren. I go ponish di third and fourt generashon, bikos of wetin dia papa do naw.”
Afta una don do like dat, den God go sey, “Make una kom make wi setol di matter naw. Even doh una don stain unasef with blood bikos of una sin, I go wosh una white like snow. Even doh una stain red well-well, una go kon dey white like wool.
E go do di same tin with dis melu as e bin do with di melu wey dem use for di High Priest sin ofrin. Na so e go take sakrifice for di pipol and God go forgive dem.
E go burn all di fat for di altar, just as e take burn di fat for di animal wey dem kill take do peace ofrin. Na so di priest go take do di sakrifice for di leader wey sin and God go forgi-am.
E go remove all di fat, just as e do with di fat for di peace ofrin. E go burn am for di altar with di food ofrin wey dem give God. As di priest give dis sakrifice, God go forgive di man.
E go bring man sheep or goat wey dey okay kon give di priest as ofrin for en sin. Den e go measure am akordin to di Tabanako shekel. As di priest give dis sakrifice, God go forgive di man.
E nor get anoda god like Yu; Yu dey forgive yor pipol wey survive. Yu nor dey vex forever, instead, Yu dey happy to show yor pipol yor love wey nor dey end.
Naim make mi dey tell una sey, ‘God go forgive pipol dia sin and all di bad word wey dem tok, but anybody wey curse or tok bad word against di Holy Spirit, God nor go forgi-am.’
But if wi dey inside di lite as en ensef dey inside lite, all of us go bi en friend and Jesus wey bi en pikin, go use en blood take wosh all awa sins komot.
But if wi konfess awa sin to am, e go forgive us kon wosh evritin wey nor good for God eye komot from awa life, bikos Christ dey always do wetin e sey e go do, since e dey raitious.