But bikos of di holy promise wey en and Jonatan don make give diasef, David nor kill Jonatan pikin wey dem dey koll Mefiboshet, wey bi Saul grand-pikin.
Di men kon tell am, “Wi swear with awa life sey, nor-tin go happen to yu! If yu nor tell anybody wetin wi kon do for here and God give us dis town, wi go sorry for yu and evritin wey bi yor own.”
So e kon promise God sey, “My papa, if Yu go sorry and remember mi, yor savant, den give mi one boy pikin, I go dedikate am give Yu as long as e dey for dis life and dem nor go ever kut en hair.”