Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Levitikus 5:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 As di priest give dis sakrifice, God go forgive di man. Di remainin flower na di priest own, just as e bi for korn ofrin.’ ”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Levitikus 5:13
16 Iomraidhean Croise  

Bikos dem dey make money from my pipol sin, dem kon dey kommit more sin.


Di remainin ofrin na di priest own; e dey holy, bikos dem take am komot from di food ofrin wey dem give God.


Di remainin korn ofrin na di priests own; e dey holy, since dem remove am from di food wey dem give God.


E go do di same tin with dis melu as e bin do with di melu wey dem use for di High Priest sin ofrin. Na so e go take sakrifice for di pipol and God go forgive dem.


E go burn all di fat for di altar, just as e take burn di fat for di animal wey dem kill take do peace ofrin. Na so di priest go take do di sakrifice for di leader wey sin and God go forgi-am.


E go remove all di fat, just as e do with di fat for di peace ofrin. E go burn am for di altar with di food ofrin wey dem give God. As di priest give dis sakrifice, God go forgive di man.


Den e go offa di sekond bird as burnt ofrin akordin to di law. As di priest give dis sakrifice, God go forgive di man.


E go bring am kom meet di priest wey go pak di flower full en hand as di sin ofrin to God, den e go burn am for di altar as food ofrin, even doh na sin ofrin e bi.


Any holy tin wey e spoil, e must pay back and e go add twenty percent give di priest and di priest go offa di animal as sakrifice for di sin wey di man kommit, den God go forgi-am.


May bi pesin make vow wey e nor sirious about, no matter wetin e bi, e don kommit sin wons e know wetin e do.


“ ‘If anybody know sey e dey guilty for wetin e do, dat pesin fit go konfess en sin.


Den e must bring woman goat or sheep kon give God as ofrin for en sin. Dis na sin ofrin wey di priest go take klean am, so dat God go forgi-am.


Anybody wey kom from di priest family fit chop am. Dem must chop am for di Holy Place, bikos e dey holy.


Una nor know sey doz wey dey work for di temple dey chop food wey pipol bring kon give God for der? Abi una nor know sey pesin wey dey serve for altar na from der e for dey chop?


From all di tribes for Israel, I choose una grand-grand papa Aaron family to bi priest, so dat dem go serve and burn incense for mi, den kon wear di priest garment for my present. And I give dem di rite to take some from di sakrifice wey pipol dey burn give mi.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan