E go take some of di melu blood with en finger kon go sprinkol am for di east side for di forgivenes plate, den e go rub am seven times for di Kovenant Box front.
“Afta dat one, e go kill di goat for di sin ofrin for di pipol, take di blood go di place wey holy pass kon rub am for di plate and di Kovenant box front, just as e do di melu blood.
E must use en finger take rub some of di blood for di altar seven times. Na so e go take santify di altar from Israel pipol sin, so dat dem go dey holy.
But if wi dey inside di lite as en ensef dey inside lite, all of us go bi en friend and Jesus wey bi en pikin, go use en blood take wosh all awa sins komot.