“Di next day, yu go take one man goat wey dey okay kon offa am as sakrifice for sin. Yu go use en blood take klean di altar, just as yu do with di melu own.
E go put en hand for di animal head kon kill-am for di nort side for di altar, where dem for dey kill animals for burnt ofrin. Dis na di ofrin wey dey remove sin from pesin body.
den if una do anytin wey nor kom from una mind and di kommunity nor know about am, di kommunity must give one yong melu as burnt ofrin to take klean demsef.
Moses Law nor fit do dis tins, bikos di yeye life wey wi dey live don make di law weak. But God don free us wen E send en pikin kom like human being wey bi sina, make e for sakrifice ensef for awa sins.