Di king kon sey make dem koll Abraham kom. Wen dem koll am kom, di king kon tell am, “Wetin bi dis wey yu do so? Na wish kind bad tin I do yu, wey yu won make mi and my kingdom kommit dis kind big sin? Yu don do sometin to mi wey yu nor suppose do!”
Nor allow yor mout make yu sin and nor go defend yorsef give pastor sey, “Na mistake I take make di promise.” Dat kind tin go make God vex for yu and E fit distroy evritin wey yu don work for!
But na only di High Priest dey enter di Holy Place wons a year. For der, e go first offa blood for en sins, before e go offa for di pipol own, bikos dem nor know wetin dem suppose to know.
But Jonatan nor hear about di swear wey en papa and di sojas swear. E kon take di rod wey dey en hand take pak di honey. Wen e chop am, en body kon fresh.