Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Levitikus 3:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 kon give all dis part to God as food ofrin: di fat, all di fat tail wey dem kut komot from near di backbone; all di fat wey kover di animal intestine;

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Levitikus 3:9
15 Iomraidhean Croise  

Dem bring di box kon put am for di place wey David make for am for di tent. Den e give God sakrifice and fellowship ofrins.


Wen Solomon wake-up, e kon undastand sey God don tok to am for dream. Den e go Jerusalem go stand for God Kovenant Box front kon offa burn and fellowship ofrin give God. Afta, e do party for all en ofisas.


Dem sakrifice 22,000 melu and 120,000 sheep as fellowship ofrin. So di king and all di pipol dedikate di temple.


Di king still dedikate di kourtyard centre with di aria for di temple front kon burn di whole sakrifice for der. E give di grain and all di fat animals as fellowship ofrins.


Dem karry di Kovenant Box go put for di tent wey David make for am. Den dem do sakrifice kon woship God.


“Since dis na di ram to take santify Aaron and en sons, yu go remove di fat for di tail, di fat for di intestine; di fat for di liver and di fat for di kidney. Yu go still remove di fat for di rite leg from di knee go up.


My pikin, listin well-well and make my life bi ezample to yu.


Na God wont make e sofa and en deat na sakrifice, so dat God go forgive pipol dia sins. So en days go long and e go si en shidren-shidren and thru am, God go do wetin E wont.


Like dis, wetin Israel pipol won sakrifice for di open field to God for di tent gate, dem go gi-am to di priest, den e go sakrifice am as peace ofrin to God.


Una go remove all di fat wey dey di animal kon offa am to God for di altar: di fat tail, di fat wey kover di intestine,


E take di fat (di fat tail, all di fat wey dey di intestine), di best part for di liver, di two kidney with dia fat and di animal rite leg.


Aaron put di melu fat and di ram


All di animals wey dem sakrifice for peace ofrin na twenty-four small melu, sixty ram, sixty man goat and sixty lamb wey bi one year. Dis na di whole ofrin wey dem give to take dedikate di altar afta dem don anoint am.


“Yu go-go Gilgal before mi. I go kom meet yu for der kon offa ofrin and make peace ofrin for der. Yu go wait for seven days, until I go kom tell yu wetin yu go do.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan