Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Levitikus 10:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 “Make yu and yor sons nor drink wine or strong drink wen una enter di tent, so dat una nor go die and dis na law wey yu and yor shidren-shidren must obey.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Levitikus 10:9
17 Iomraidhean Croise  

Aaron and en sons go dey arrange di lamps from morning till evening before di Oga dia God. Dis kommandment na for Israel pipol and dia pikin dem and e go dey forever.”


Too mush drink dey make pesin tok and bihave anyhow and pesin wey dey drink too mush, nor get sense.


Even di profets and di priests dey stagga bikos dem don drink well-well. Dem don drink plenty wine and e dey konfuse dem. Dem don drink sotey dem nor dey fit undastand di vishon wey God send kom or judge any kase well.


Priests nor go drink any wine before e go inside di kourt.


God sey, “Bikos my pipol dey drink old and new wine, dem nor get sense again.


“ ‘Make una nor ever chop any fat or blood and Israel pipol must obey dis law from one generashon go rish anoda.’ ”


Den, di priest go give dem as special gift to God; na holy ofrin for di priest, with di ram breast and leg, bikos na di priest own akordin to wetin dem rite for di law. Afta dis, di Nazirite go fit drink wine.’


e must nor drink wine, strong drink or vinegar wey dem make from wine or strong drink; e nor go drink any juice wey dem make with grape and make e nor chop any grape weda na fresh or dry one.


bikos God go use am well-well. E nor go drink wine or strong drink, but di Holy Spirit go dey inside am, even before dem go born am.


Make una nor dey drink strong drink, bikos e go distroy una. But make una allow God Spirit fill una mind.


Make e nor bi drunkard or pesin wey like to fight; but e must dey gentol. Make e nor bi pesin wey like to kworel or love money.


Like dis too, deakons must bi pipol wey get good karata; nor bi pipol wey dey play wayo; dey drink anyhow or love money.


Nor dey drink only wota, but make yu still drink small wine bikos of yor belle wey dey make yu sick anyhow.


Make pesin wey bi leader nor get fault, bikos na God work e dey do. Make e nor dey karry body up; dey kwik vex or drink anyhow; dey like to beat pipol or love money.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan