Elijah ansa di soja oga, “If I really bi profet, make fire kom down from heaven kon burn yu and all yor sojas!” At wons, fire kom down, burn all of dem.
As e still dey tok, anoda savant run kom kon sey, “Oga! God fire fall kom from heaven kon kill all di sheep and doz wey dey guide dem and na only mi one eskape kom tell yu.”
Den God tell Moses, “Make yu klimb kom meet mi; both yu, Aaron, Nadab, Abihu and di seventy eldas for Israel and wen una still dey far from where I dey, make una bow woship mi.
Dem don already prepare di place where dem go beri Israel enemies put; dem don make am deep and wide for dia king. Dem don gada di firewood and God breath wey bi like fire and sulfur, go kom like river wey dey flow kon distroy en enemies.
At wons, di woman fall for groun kon die for Pita front. So wen di yong men enter inside di house kon si sey di woman don die, dem karry am go beri near where dem beri en husband put.