Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Levitikus 1:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 “ ‘If di man dey give one sheep or goat, e must bi man own wey dey okay.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Levitikus 1:10
22 Iomraidhean Croise  

While Abel bring some of di first-born for en animals wey fat pass. God like wetin Abel bring,


Noah build one altar for Oga God. E kon take some from evry klean animal and bird take offa ofrin for di altar.


Make di animal wey una choose dey okay; animal wey neva pass one year and e must bi man sheep or goat wey nor dey cripple or get sickness.


“Di next day, yu go take one man goat wey dey okay kon offa am as sakrifice for sin. Yu go use en blood take klean di altar, just as yu do with di melu own.


“For di eight day, e go bring two man lamb and one woman own wey bi one year and dem must dey okay and if dem divide flower bag into ten, e go bring three part wey dem mix with olive oil. If dem divide one lita for olive oil into ten, e go bring three part kom.


“E go fit enter di place wey holy well-well only afta e don bring one yong melu for sin ofrin and one ram for burnt ofrin.


Israel pipol go give Aaron two man goat for sin ofrin and one ram for burnt ofrin.


If I go kollect am, den di animal wey dem go offa weda na kattle, sheep, or goat must dey okay.


For di day wey una go offa di korn ofrin, una go sakrifice man lamb wey dey okay as burnt ofrin to God.


“ ‘Wen pesin won give en animal as peace ofrin, e fit bi man or woman own, but di animal must dey okay.


den as e just know sey e sin, e must bring woman goat wey dey okay as en ofrin.


“ ‘If na di High Priest sin kon make di pipol dey guilty, e go give one yong melu wey dey okay to God for en sin.


“Wen anybody disobey mi by mistake kon kommit sin as e nor obey God holy propaty, den e go bring guilt ofrin to God. Di ofrin must bi en own ram wey dey okay, or e fit use silva take buy betta one, just as dem dey measure am with di Tabanako shekel.


tell Aaron, “Make yu take one yong melu and one ram wey dey okay kon give dem to God. Di melu go bi for sin ofrin, while di ram na for burnt ofrin.


Curse dey di pesin head wey dey play wayo and offa yuzles animal, wen e bi sey e get many betta animals wey e promise sey e go give mi! I bi strong king and all di nashon dey fear mi.”


togeda with one lita of wine for drink ofrin.


“Dis na my kommand: ‘Make una tell Israel pipol make dem bring red melu wey dey okay and wey dem neva use take work before.


kon give God three animals wey dey okay: lamb wey bi one year for burnt ofrin, iyu lamb wey bi one year for sin ofrin and one ram for fellowship ofrin.


Wen day break, John si Jesus dey waka kom meet am, den John sey, “Make una look! Dis na di Sheep wey God send kom die, so dat God go forgive us awa sins.”


but na with Christ blood and na dis Christ bi God lamb wey nor get any mark or stain.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan