God kon tell mi. “Man pikin, go tell Israel pipol wetin dem dey tok: ‘Na awa sins and di wrong tins wey wi dey do, dey ponish us so. Wi don die finish so how wi won take survive naw?’
Na wiked diziz go kill dem and nobody go mourn or beri dem. Dia dead body go full groun like manure. Na war and honga go kill dem, den bird and wiked animals go chop dia dead body.
Dem sey, “E for betta sey God kill us for Egypt, bikos wi even dey si food chop for der, but naw, E take us kom dis wildaness won kon kill us with honga!”
Dem go chop una animals pikin and una plants, den dem go distroy una. Dem nor go leave any korn, new wine, olive oil or animals for una and una go hongry die.
Pipol go dey fight each oda for street, but for house, na sickness and honga go dey der. Anybody wey dey outside di town go die for di fight and evribody wey dey house, na sickness and honga go kill dem.